*Single But Living Married* Episode 2 Bola was in the - TopicsExpress



          

*Single But Living Married* Episode 2 Bola was in the kitchen later that day, Kay’s girlfriend was also around and I went to pick up something Bola: What was all were doing in the sitting room Me:as in? Bola:You dey ask me as in? because I no wan cast u in front of boys make dem no make jest of u Me:I no understand wetyn u dey talk Bola:Ehn..ehn… I go come burst u then Me:I no say u no go wan do like that now Bola:Why u com dey deny like say u no know wetyn dey happen b4 Me:Why u sef dey sample my Dickson Bola:Konji na bastard to God…………………U dey miss oo guy Me:I hear u Bola: äbi make I carry u go bleep ashana? Me:why now…e never reach that level now Bola:Guys no go know..we go just do am codedly Me:U dey craze…..Thank u, I no need am Bola:U no need am but with this way wey u dey go, make u no go rape me or any lady for this compound one day Me:U sef arrange me one correct babe now Bola:sincerely, no one wey I fit recommend for u now cos u dey reserved but we go see how e dey go Me:na wah ooo…na me come turn this way..even u sef no dey help matters Bola:wetyn I dey do again now… Me:U go just dey put person for agro all the time Bola:Hehehe…see me see trouble oooo…e be like say I go dey fear u as from this moment ooo Me:wetyn dey do you now…why u com dey raise your voice , shut up jhoor (spank her Bottom) Bola:E gbami ke (make una help me)….wetyn be all this now Kay:wetyn dey happen there? Bola:Na snakie ooo…….make una com call am commot for here ooo…e just dey tap current for my body Tunde:I hope say u safe there sha Bola:I no sure oo..make una..abeg make I commot 4 am abeg..e no even want make I pass sef Me:hw I take dey block u now……… Bola: Commot for road jhoor…… (she pushed me away) That was how she ran out of the kitchen……… Kay: wetyn happen now? Abimbola: No mind this snakie oooooo Tunde: Wetyn e do? Abimbola:e just dey tap current for my body……free of charge for that matter Micheal: lolzzz……….Padi mi ti kun, o fe tu si e lara pupu ni (My friend is filled up, he wanted to discharge) Abimbola:If e want to discharge, na my body come be dumping ground? Tunde:You can help a brother now…….snakie na ur broad now Abimbola:Una dey craze, una want make hin kill me with that big rod wey hin carry 4 that place Kay:Which kind big rod, u don c am before Abimbola: na today?i wish una fit see how the tyn stand inside kitchen now………. Tunde:Talk tru bimbola, u feel the thing abi u don feel am b4 Abimbola; U dey craze………. Micheal:U no even fit risk to take am once Bimbola cos if u do, wallahi u go divorce ur boyfriend Abimbola:I no even fir try am…..shade wey take am sef try…the babe na master Kay:Snakie oooo….hmmmmm, ekun Me:which kind nonsense be all this one now…..abeg make una talk another topic jhoor Kay:y u sef dey go tap current for Bimbola body..take am easy o guy Me:U dey craze…………… Abimbola:Sincerely, na so e remain, snakie don almost start to press my bobbie Micheal:lolzzz…..File, how the bobbie be snakie Me:and una dey believe wetyn she dey tell una Tunde:If u no touch her she go shout Abimbola:Thank you jare Tunde…………I even dey fear am now sef, make e no be say one day una no go day and he go r.ape me inside house Kay: na to dey wear iron trouser anytym u dey house with am b that…. “laughter everywhere” Me:Una no serious………….All of una dey craze with due respect. Me:wait oo…e be like say I dey hear noise from outside oooo Tunde: Ehn..ehn Micheal:Neighbour and his girlfriend don start again b dat Me:which kind person b this guy sef, wey go just dey beat his girlfriend up and down Kay:how that one take concern u…Na love now Me:love ke? I just hope say dem no go kill each other for inside this compound one day Tunde:e concern us Me:All of una go just dey do I don’t care on top their matter..e no good ooo Abimbola:How e take concern our life now….na wetyn dat geh eye dey find e see Me:U wey be woman no suppose dey talk like this now Abimbola:I no send her mama now….na 4 the guy to kill am go make me happy sef Me:e reach like that Bimbola Kay:na wetyn go pay her be that now..u no say she her d babe no dey talking term Me:wetyn happen? Tunde:Dem dey beef each other unto say the babe dey feel say Bimbo dey yansh hin boyfriend Me:lolzzz Abimbola:Una no see me, even if I wan yansh somebody, na hin boyfriend e go be? Wen guys yapa 4 here Kay:File…..maami Micheal: mama oooo………make we enter go do one round now abeg Abimbola: U dey craze, e be like say u wan die there abi…na where u follow come u wan follow go back Abimbola “Leave me oooo Micolo, which kind thing be all this one now, Ahn…ahn….u don dey press my bosom ooo……….this one dey craze ni, I go cut ur p***k oooo……” Kay “oshey micolo…oya make una enter…….enter the room…..i don open for una” Abimbola: I go knack stick for ya head ooooo……. Micheal : Stop jhoor Bimbola, your hand don dey go near engine room oooo……….oya pls… pls pls abeg before you put me for agro Abimbola:sebi na u wan do something now…… craze boy, na only snakie be gentle guy among una “she came to sit beside me” To be continued
Posted on: Mon, 12 Jan 2015 13:51:29 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015