* U dey do opening prayer 4 Night Club. - Na God go slap ur mouth - TopicsExpress



          

* U dey do opening prayer 4 Night Club. - Na God go slap ur mouth :P * U come back from dubai dey form British accent. - Na rat go chop ur mouth :) * U be house boy u come dey play Rick Ross - I am the Boss. -4 where na.....mumu :v * U dey add water to egg say e go plenty when u fry am. :( - Why u no add yeast join am....olodo. * U no go university, and u dey find ur name for NYSC posting. - Na yeye dey worri u. >:O * House dey burn, you wan use gas do fire extinguisher - Hahahahaha....udon die. :P * U de say Terry Gs music dey inspire u - unto which level!! madness :v * U carry candle dey look for where fuel dey smell from. :v -continue u go soon see am * U call MTN to tell dem sey ur free browsing has stopped working. - Lolz ..mad man :P * When pastor talk say Do something crazy for the Lord u come carry church offering run - na who wan chase u? :( Good morning #famz :v :v
Posted on: Tue, 23 Dec 2014 06:31:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015