1 The Lord na my shepherd. I dey kampe. 2 E make me sidon 4 where - TopicsExpress



          

1 The Lord na my shepherd. I dey kampe. 2 E make me sidon 4 where beta dey flow. Come put me next to stream make my body thermacool. 3 E panel beat my soul com spray am white. com dey lead me dey go 2ru express road of righteousness sake of his name. 4 Walai, evn if i waka pass where boko haram dey, join okada and trailer reach valley of shadow of death sef, my body dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so dem dey lyk backbone dey comfort me. 5 You don prepare egusi and pounded yam make i chop. All my enemies jst sidon dey look waa waa lyk dog. You rub me 4 head with vaseline intensive lotion and goya olive oil. My cup con overflow lyk bar beach water. 6 True true, beta lyf and mercy go dey folo folo me 4 bck till i quench and man pikin go stand fit lyk elephant 4 God haws frm lai lai til lai lai. Naso
Posted on: Tue, 15 Oct 2013 05:48:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015