13TH JAN, 2015, AUCHI POLY LIVE NEWS #UNA GOODING - TopicsExpress



          

13TH JAN, 2015, AUCHI POLY LIVE NEWS #UNA GOODING MORNING #GREAT POLYTES! BLIND PERSON DE DREAM FOR NIGHT O BBM. 223202AC PHONE No. 08101006164 How your night go? Today we don carry another ogbonge TORI cum for una from our Abuja Studio. ___ For my pipo way de watch football match, C.Ronaldo don win World best for the 3rd time. ___ Barcelona pikin way be Lionell Messi, because im no win World best, the guy don vex say, im de live Barcelona for next season oo. ___ Dey don turn Auchi Polytechnic to jattu market ooo, as Muslim de do der convention for der.... Picture later... ___ #PAID ADVERT: Welcome all Pub Admin student of SES ND1, for more details about your dept clearance, school fees make you call una Acting Class Rep way be Louis for 07062368491 only for Public Admin Student. ___ IF you get anything at all way you wan ADVERTISE with us make you inbox us, as we go publish am for our tomorrow news for free... ___ We don open the door as for any body way wan come in, if you wan go for CLASS REP, make u inbox as we go give you the Secrete on how to go about am. MORE NEWS for our evening Tea. #QUESTION_OF_THE_DAY? Na which year and which person change d name to Auchi Polytechnic? Na here we go talk reach for today more news go cum ya way tomorrow same time , same venue, una bye bye FOR MORE INFO MAKE YOU ENTER AUCHI POLY GROUP CHAT FOR HOTTEST NEWS FOR CAMPUS.... Have a blissful day
Posted on: Tue, 13 Jan 2015 08:41:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015