22-TUESDAY- DEC. 2014 AUCHI POLYTECHNIC DAILY NEWS A Bad - TopicsExpress



          

22-TUESDAY- DEC. 2014 AUCHI POLYTECHNIC DAILY NEWS A Bad Behaviour Is Like A Flat Tire, You Cant Go Anywhere With It Unless You Change It E don come to Our Notice say almost 70percent of our members no dey see this Our News Update in full, Dem dey see am Half unto say Na FACEBOOK MOBILE dem dey Use, Abeg if you wan view the full News Update make Una try dey Use beta App browser E.g Opera Mini SPAT *SPAT Aspirants Blood jxt dey hot unto the Admission List and the Criterias wey dem go take give dem Admission. The funny part be say, Nobody don even Ask me when the CBT Result go come out, All Of dem jxt dey Ask me About The Admission List. I still dey Advice Make Una get Hope and Faith in God bcos Na only these Criterias go give Una Admission. *RESUMPTION Resumption date for the Regular/Morning Students Na 19th of January. While for SPAT na January Ending. But If Any Adjustment Happen, I no go also fail 2 Inform Una. *If you know say you newly get Admission for HND1 Microbiology and You Never Resume, Una don miss Alot & for better Clearification make Una try Contact SOCRATE THE MANDATE bcos he na Student there and he also dey Look forward to the success of him fellow Coursemates. *For My Newly Admitted SLT Brothers and Sisters when never Resume Also, Make Una try Resume on time oo, Bcos test and sumbittion of Assignments dey Immediately after Resumption-MR ENDOWED 4RM WAPJUNIOR *Oga Wapjunior dey Wish All the Polites A Very Happy Xmas n A Propserous New Year. He also Say make I Advice Una make Una Celebrate dis Xmas Well and Make Una Also Play Safe during dis Celebration Period Contact Wapjunior via 08101006164 Or with him BBpin 223202AC Team Wajunior Cares. 4RM SOCRATE THE MANDATE Oga Socrate they Wish All the HND1 Microbiology Students, School Of Applied Science & the Whole School In General *HAPPY XMAS CELEBRATION* 4RM MR ENDOWED I dey use dis means dey Wish All my SLT brothers and sisters, the whole School of Applied Science in Geenral A Happy Xmas n A Fulfiled New Year SERIOUS NOTE Make Una dey Officially informed say Nobody dey pay us for this Our Ogbonge Work(it is now left for the recievers to compliment Us), We dey do am Out of Goodwill for the betterment of Our fellow Polytes. So make Una no let Anybody dcive Una say dem dey Pay Us Oo Be Guilded! GENERAL NOTICE For Ur Occasion, Event, Ceremony, And you dey Look for Ogbonge MC wey go make that Event be Talk of the Day Make Una no fail to contact the Only MC wey dey give Hope to the Hopeless and Faith to the Faithless, Him Name na MC LECTURER. Contact MC LECTURER for ur ceremony, Event, Party ETC *I don ready gidigba 2 make sure say I give my Polytes the maximum information wey dem need, With God all things Are POssible. Make Una try dey In touch with AUCHI POLY GROUPCHAT or Auchi Poly SPAT bcos na 4rm there and here you go dey get the daily event wey dey Happen for Inside Campus. *I wan Use this Opportunity take thank Our School Fathers n Mothers wey be Our Lecturers. Na God go Bless Una for Us. I dey use dis means wish Una Happy Xmas n Prosperous New Year in Advance-MR ENDOWED Na Here I go Stop for Now Dis Na 4rm Una Own Pikin MR ENDOWED
Posted on: Tue, 23 Dec 2014 09:57:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015