99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- One 31yrs old man wey - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- One 31yrs old man wey him name na Kelechi Williams don kill him woman lover wey her name be Njideka Lizzy and she bin be 39yrs old. Dis madam Njideka na Oga pata pata for one very big company inside Lagos and she get four children. This guy kill him lover around 2 O’clock in the night of July 19th 2014. After him kill her, him carry her money wey reach like 8 Million naira and her Range Rover Sport run comot from haus dey go Ghana according to Police. But as e dey now, Police don gbab dis guy and wen dem begin ask the guy question, him say him kill her bcos of jelosy say she go out and she no come back on time, and wen him dey call her she no gree pick her call only for her to comeback drunk come say she bin put her fone for silence. Now I dey ask, with the age difference between these two lovers and plus the way him kill her come carry her come even carry her 8Million Naira and Range Rover dey run go Ghana, you agree with am say nab cos of jelosy him kill her and wetin you see for this matta. Which kain punishment you think say dem fit give dis guy? LadyG (@ladygdgenius) and Oche dKing (@ochewazobia) dey in da haus. #KuleleZone #9jaHowUnaSeeAm Tel: 0709-2222-995 Whatsapp: 080-999-30172 Twitter: @WazobiaFMAbuja wazobiafm/abuja995
Posted on: Thu, 07 Aug 2014 14:16:10 +0000

Trending Topics



="min-height:30px;">
Yawdah ini cerbung ny Cinta sejati 4 pangeran kece part 1 No
Where are my bath people? Right now I have some bath salts and
HTC / T-Mobile G1, G2 Cell Phone Compatible 4GB Micro SDHC Flash
As followers of Jesus who are also citizens of the nation with the

Recently Viewed Topics




© 2015