99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- Presido Goodluck - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- Presido Goodluck Jonathan yesterday don ask Senate say make dem join hand sign so dat Ogbonge Gov’t go fit borrow money wey go reach like One Billion Dollars, dat na like One Hundred and Sixty Billion Naira from outside Naija so that we country go fit use d money solve the Boko palava wey dey face we country. Presido say Naija go use dis money upgrade we security equipment, train more personnel and even follow do security waka so dat dis insurgency palava go end for we country. Now I dey ask, you support we Presido for dis borrow money waka wey him wan do to stop security wahala for Naija? Give us your reasons. LadyG (@ladygdgenius) and Oche DKing (@ochewazobia) dey in da haus... #KuleleZone #9jaHowUnaSeeAm Tel: 0709-2222-995 Whatsapp: 080-999-30172 Twitter: @WazobiaFMAbuja wazobiafm/abuja995
Posted on: Thu, 17 Jul 2014 14:11:52 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015