99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Tori For Town: For inside lastweek Friday, - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Tori For Town: For inside lastweek Friday, Enugu State High Court bin collect one customer, John Ugwu wey be okada rider, wey dem hold ontop rape matter. The prosecutor, Mrs. Chinyere Ugwuja talk say John bin rape her client as im bin dey carry her go Amaeke Ngwo village for Udi Local Government Area of Enugu State on May 25, 2011 & say nah eyewitness naim bin alert police wey bin rush come around 10pm to take rescue her client wey be John victim. She come yarn join say John bin pick her from 9th Mile as she bin dey come from Onitsha, but instead wey im go carry her go wher she dey go nah so im bin branch one bush wher im bin rape her & say make court just give am judgement straight, sake of say John nor get case to defend for inside the matter. But Mr. Emeka Uzoegbu wey be John lawyer talk say im client nah just okada rider wey dey hustle for im daily bread for 9th Mile area & say nah true say John bin carry im customer go her uncle place wey dey off Ama Brewery area, but im bin nor rape her at all. Mr. Emeka Uzoegbu come yarn join say small disagreement bin dey between John & im customer ontop money wey im bin charge im customer wey bin lead to small fight wey be say im bin still nor rape her, say nah as John dey waka come back to 9th Mile bus-stop, wey im decide to enta bush to take go toilet naim police bin arrest am ontop rape matter. Naim Justice Afam Nwobodo wey in-charge of the court bin adhjourn the case till Oct 2 for further hearing... Bigmo (@bigmoNaija) & Yaksman (@yaqsmanwazobia) first do “hmmm!!!” before we ask how take u weigh dis matter? #UnaWakeUpShow #ToriForTown #TearRubberWeek Twitter: @Wazobia_Fm Tel: 094-600-995 wazobiafm
Posted on: Mon, 29 Jul 2013 05:25:30 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015