99.5 WAZOBIA FM ABUJA: W.W.W!!! Tori For Town: Just afta 10days - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: W.W.W!!! Tori For Town: Just afta 10days wey one 13years old boy, Daniel Ricky Oikhana bin dodge pass security people for Benin Airport to take enta one Arik Airline aeroplane tyre take fly from Benin to Lagos. We hear say anoda 27years old man for inside Monday afternoon bin wan do the same thing for the same Benin Airport, but im im plan bin fail dis time. Airport security people talk say the man bin lie down dey wait make im enta one Arik airline aeroplane wey dey go Abuja to land for Benin before im enta the plane. Chief Security Officer of the airport, Mr. Adeboye Festus bin confirm the tori & say dem don hold the man for the Airport police station. Wen news people bin dey ask the man question, im talk say im be psychiatric patient & im don taya for life… Bigmo (@bigmoNaija) dey ask wetin u see for inside dis matter? #UnaWakeUpShow #ToriForTown #WonderfulWednesday Twitter: @Wazobia_Fm Tel: 094-600-995 wazobiafm tribune.ng/news2013/index.php/en/news/item/20650-27-yr-old-stowaway%E2%80%99s-attempt-foiled-in-benin.html
Posted on: Wed, 04 Sep 2013 05:26:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015