99.5WAZOBIA FM: 9JA HOW UNA SEE AM: -One paper wey dem wan turn to - TopicsExpress



          

99.5WAZOBIA FM: 9JA HOW UNA SEE AM: -One paper wey dem wan turn to law wey go make am easy n simple to fit impeach anybody wey be Presido and Vice Presido of dis country yesterday pass second reading for House of Representatives. Dis mata dey find how to correct Section 143 of we 1999 Constitution (as amended) to remove all d stress wey dey d process of removing Presido n Vice Presido from chair base on accuse of serious ojoro, wuru wuru n wasting of money. Na Yakubu Dogara carry dis paper reach d House, and dem want make dis waka be like d America style of impeachment, wey go carry d power n right of to comot Presido from chair give National Assembly.. LADYG(@ladygdgenius) and OCHE D’KING(@ochewazobia) DEY IN DA HAUS….
Posted on: Wed, 05 Jun 2013 14:26:55 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015