9JA HOW UNA SEE AM:- One joinbodi wey no dey work wit Gov’t - TopicsExpress



          

9JA HOW UNA SEE AM:- One joinbodi wey no dey work wit Gov’t (NGO) wey dem dey call ‘100 Women Lobby Group’ don joinbodi wit Ministry for Women Mata and Social Develop to tell Naija piple say make dem try vote for women during the 2015 General Elections. The National Coordinator of dis NGO, Felicia Onibo, talk say dem dey yarn dis mata bcos dem want make all the Political party for Naija begin dey use Women as dia Deputy Governors so that politics mata go balance and e go make plenty women comot to vote. As truth and important as dis suggestion look, you fit give example of any Governor wey don use woman do Deputy before and tell us how dia government go. Then how you see dis suggestion wey dis Madam bring, you think say e good, you like am or not let us know and why? LadyG (@ladygwazobiafm) and Oche DKing (@ochewazobia) dey in da haus. #KuleleZone #9jaHowUnaSeeAm Tel: 0709-2222-995 Whatsapp: 080-999-30172 Twitter: @WazobiaFMAbuja wazobiafm/abuja995
Posted on: Thu, 11 Dec 2014 14:07:44 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015