9JA PIDGIN QUOTES,MAKE THE LIST CONTINUE pikin wen use agbada take - TopicsExpress



          

9JA PIDGIN QUOTES,MAKE THE LIST CONTINUE pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old before you marry woman make u look e mama well because mango nor dey fall far from tree pikin when no know him mama boyfriend na him dey call am uncle. Escort me, Escort me, naim slave trade take start. When monkey wear canvass enter town make we know say im get plans Na determination dey make okada rider overtake trailer na lazy person dey run go house go pull shirt if dem find him trouble 4 field threaten na water, action na blood! Pig say swagger get level na im make am pack im own balls go back No matter how u go under water go mess the gbudu-gbudu must come out. Bullet wey meet face cap no be warning If hand shake don pass elbow na fight. Fowl no dey bubble for night.
Posted on: Wed, 31 Jul 2013 22:34:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015