9ja babes just de snap and post only their new hair, ear rings, - TopicsExpress



          

9ja babes just de snap and post only their new hair, ear rings, necklace, and the upper parts of their face like say na passport. Facebook na JAMB website? Some go twist their mouth like Beyonce... Later, dem go come tag the passport #DowoFwesh... Dem no go sabi spell again... Ndi mmacha... Abeg make una de post full photo make guys de know the ones we get k leg and those wey get nails and toes like Nebuchadnezzar own, 2 avoid embarrassment! Na so I inbox one wey just post her milk industry, I think say na real babe wey go sabi d tin. she replied and we became friends...later she say make I visit her which I never argued naaa, she come direct me and say any day wey I wan come, make I tell her on time, say their gate man fit no open gate for me. But na yesterday me decided to go and as devil will have it, me no come get credit 2 call or txt.. I come decide to ask pple...I meet one baba 4 road wey tell me say I don already reach deir hauz, I say no wahala. D baba come say if I go left, I go c one yeye small shrine wey dey use red cloth cover, and opposite the shrine na their hauz... O boy I started praying, asking God 4 protection...when I get there, omo see dis babe wey tell me say deir Gate Man fit no open gate for me... Nnaa men, if u see as the baby de break palm kernel, u go think say her life depend there! Abeg when girls go stop lying and start telling truth like we guys?
Posted on: Fri, 31 Oct 2014 09:27:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015