A.M NEWS! From our studio here we send salute give every body weh - TopicsExpress



          

A.M NEWS! From our studio here we send salute give every body weh get the heart to make Jesse Better! As Tafia nor deh insult people again so e nor mean say people go deh misbehave o. I deh hear all the attack weh people deh plan for Tafia and na so dem deh greet Tafia if dem see me. So Tafia have been duly cleared by the Almighty to go ahead. Hon Anthony Akpomiemie na your transformer we deh wait now. And I want make you try bring am as quickly as possible because the four years weh unu represent Jesse we never still see wetin u do to take be political leader. Hon John Nani u don sabi say nor be only bad we deh talk. So make unu try fasten the installation of the transformer make the thing for fast because that na one big problem weh Jesse get. Ododo 1; I wan officially inform you say dem don mark many houses for the new road weh dem wan construct so. I deh beg you make unu call the contractor to order make dem make sure say dem compensate any small block weh the thing affect because we nor want anything weh go bring wahala come the town again. We send message give all the Councillors weh go represent their greedy self and till now we never hear from them. So I wan list their names here both past and interim make dem gather money buy one transformer for us and any one weh we nor remember mention now nor commot o. Make this ones help reach them. 1.Anthony Atima 2.Stanley Akpaka 3.Fidelis Iyendo 4.Bright Igbi 5.Ketiency Akpovwovwo 6.Onojaife 7.Owoso 8.Onosa 9.Jerry Aghomi 10Baby Ameh 11.Moses Macaiver 12.Mrs. Akpovwovwo weh be vice now and others weh we nor count now because unu time na unu pocket money unu go find. Pemu weh get black camry weh don graduate don too do for the town. Pemu na last year u drive your small girl weh born for you and you come give Ojevwe belle put for house. Now you don deh run leave Ojevwe deh carry small small girls follow town again. Abi unu wan still run leave her? Unu own don too much make unu leave small girls alone for the town. DPO for Jesse police station, unu nor deh see say that trailer weh deh unu front so nor good there? NA the only good spot weh deh that place na e unu truck don block so and small children deh cross there every time. Make unu make effort remove them. And make unu reduce unu bail money because e too high. Sunday NEPA make unu tell unu oga and unu people make unu deh trace the line before unu go give power. Many poles don rest and dem deh carry live. If unu nor do well unu light come kill person for the town unu go die too. Make all the chiefs dem warn the army say curfew nor deh Jesse and make the army patrol. Dem nor say make dem come deh close beer palour by 9:o clock. Dem fit pack maintain peace. Report fly enter our studio say the Atiwor road weh political follow follow confirm to us in an interview say na Agoda do am na lie. As e be say na the Nani maintenance still deh work so. So we wan use this medium beg Agoda make he use the money for the re-construction take chose one of the roads for Jesse make we nor lose the money like that. As the road long so e fit work on Ijomi road, Mission road or water board road. Unu weh deh handle community cases make unu deh talk true and make unu nor deh allow people deh swear because na when unu nor fit handle issues e go result to that. This Jesse weh we say make e better so na for peace and nor be katakata or swear. Wisdom omoniyodo as today be market day so make unu remove unu vars from the road make people fit pass. Make I go bobby wife place go eat grass-cutter first. JESSE MUST BETTER!!!
Posted on: Sat, 29 Jun 2013 09:07:45 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015