A.M NEWS! From our studio we send greetings give all of unu weh - TopicsExpress



          

A.M NEWS! From our studio we send greetings give all of unu weh want make the kingdom better! Tafia wan thank all of unu weh pray for the peace and security of the kingdom especially for the primary yesterday. Make unu prayer nor stop because we need to enter the new year with songs of thanks giving. Report fly enter our studio say the house of rep primary weh dem do for Oghara stadium yesterday na Lovett Edirin Edisi win am. The report follow say Amori weh stand for Nani back since say make he nor ever withdraw interest because say dem don hold he hand, go give he vote to Lovett Idisi instead of Nani.The report follow say Nani people deh rejoice say at least their oga get second place. Na only fool deh happy say he own house deh burn. This one don show say Amori nor want make the position come Jesse that na wetin make am use the two leaders head take jam each other make the rep for go Ethiope East. Tafia deh call on well meaning children of this kingdom make their eye open to the way the two leaders put selfishness for the politics first before the interest of the kingdom. This na because if any of them get the interest of the kingdom and the ethiope at large, dem for step down. Tafia deh call on the people of the kingdom weh go school make dem for a very formidable ELITE FORUM so that we go fit deh stop those kind self centered leaders for future. And so that we go know say the fate of the kingdom nor deh the hand of the two yeye idiots weh claim say na either dem or no one else. Because that kind character don old. People weh go school nor deh do thing with desperate like that. Tafia wan tell Amori say all hope is not lost yet because we still get one son weh be SOTA weh deh run for the same position. So Tafia deh use this time take call on all sons and daughters of the kingdom make unu drop party interest make unu put the interest of the kingdom first. Make unu make sure say unu give unu vote to captain SOTA because we still get small chance to take get the rep even of nor be through PDP. Tafia deh call on the two leaders weh be Agoda and Nani make them look back at wetin dem do so. Make dem check to see whether na the right thing dem do or na very very yeye thing dem do. As dem use the personal pride take let our chance go another side. Anyway, betrayal deh inside politics and from the way things deh go since I know say betrayal go enter the matter. And I never ever trust the mosogar and Oghara axis since the issue deh ground so I was right. Unu weh be Johnson Okpoh weh deh calculate delegates since say na unu oga get all the delegates shey unu eye don clear? I deh even wonder how u take be ward chairman for Jesse come still be delegate for Jesse when everybody know say na Oghara man unu be. All those na the bad work of Nani because we get very responsible and good headed people weh fit run the chairmanship of the ward and also be given the delegate slot but as usual dem deh play politics with every little thing and very soon unu go still be Councillor for the ward as e be say na personal interest deh over ride the general interest of the kingdom. Na like this dem take give Councillor to Onoriode Uyo weh not fit spell he own name for this modern days weh be say plenty graduates deh the kingdom weh nor get job. Politics na for good representation nor be to give opportunity to people weh nor know anything make dem for compensate them with the small gossip weh dem don carry come leader. If unu feel say Tafia deh lie make the two councilors from the big ward 3 come defend themselves with ability to construct simple sentence. Because unu forget say unu Councillors deh disgrace the kingdom for Oghara everyday. How unu go rate pikin weh deh spell Syves ter in place of Sylvester? And yet the pikin even try pass the two current Councillors from the big ward 3. I bet everyone say dem nor fit spell correctly the work Councillor at any point in time. (Oya make unu bring unu insult give Tafia weh be ghost). Make unu get am for unu mind now say if we had played the politics well, we for get at least one house of rep and one commissioner for a start. But now na prayer we deh make we for get them because we now have to make sure ALL Idjerhe vote goes to SOTA and any Idjerhe person weh vote against SOTA nor worth to be the son of the kingdom. Bishop Ameye we thank you for the continuous programme and prayers weh unu get this period. Tafia still hear morning prayers from many churches and the one weh deh Jesse garage weh be CMS Church still deh on plus other churches weh deh do December period. Tafia deh call on all the children of the land make dem go church deh go pray for their life and family and for our king and the kingdom. Tafia deh use this medium invite all of unu to the marriage ceremony of one of Tafia stubborn fan weh deh wan cut off Tafia head - VICTOR OYIBO DEDEGBO aka SENATOR. Dem wan formally do their marriage blessing and reception today. Make I rush go Atiwor river go take my bath make I enter church for Omiemiemiemie side. JESSE MUST BETTER!!!
Posted on: Sun, 07 Dec 2014 06:41:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015