ABEG NO LAUGH...just need ur advise... My Blackberry don chop my - TopicsExpress



          

ABEG NO LAUGH...just need ur advise... My Blackberry don chop my money tire, na him I come vex yestaday sell am, come take some money buy China phone! Now am in bigger trouble!!! 1. E go full after 3 minutes of charging. 2. The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Fire lighter etc. 3. I fit write Text message with a toothpick sef. 4. The spelling get mistakes e.g, NokLa, blackderry, i-pon, samswag etc. 5. When aeroplane pass e go record One missed Call. 6. When a big car horn; e go show Charger connected 7. When Chinese man pass e go show: One Bluetooth device found 8. When fine lady waka pass, e go show WiFi On 9. When ugly lady waka pass, e go show, Virus detected Abeg I wan sell am! Who wan buy ooo? Even as I dey find buyer, e dey show me for screen say No contact found. Hapi new months 2 u all friends. Pls make una help me whats dey next step with dis my fone ?
Posted on: Mon, 01 Sep 2014 10:34:59 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015