AFTERNOON UPDATES. 12/07/2014. Due to say we dey go off air - TopicsExpress



          

AFTERNOON UPDATES. 12/07/2014. Due to say we dey go off air soon,we decide to run down some updates for public digestion. Hon. Julius Egbedi and Happy Overah don dey defraud Sapele Local Government Treasury as dem dey add people wey nor dey Government names enter Sapele Local Govt Salary names and dem go cum agree with d fake Local Govt workers to withdraw the money,den give dem 85% of the total money wey dem pay into d Salary Account wey d pipo open for d purpose. As unu dey defraud the Council na so God go allow Devil defraud unu,as e permit Devil against Job for Bible. Report enter studio say Hon. Ben Igbakpa and Hon. Frank Omare don tire to demolish people Houses. Wen i use my Ghost Mirror take spy Ben Igbakpa for night,i see am dey turn anyhow for bed like who swear dey worry. Nor be small prayer e fine wife pray for am wen e dey sleep dey cry like who poor pipo prayers dey pursue. Wen i spy Omare i nor fit read e mind,becos inside black pass Chacoal. The people wey dey Gana area don almost use deir hand render themselves Homeless,as all of dem don dey break deir illegal structures wey dey d road. Report enter studio say IDSL don dey round up deir wiring as dem don carry deir wires cross River within Sapele,People Houses,Churches,Schools and Roads all in the name say dem dey find oil. When we inspect the minor damage wey dis thin dey do,we cum throway call to the Community Chairman Moses Ogodo,so during the converstion we come agree say anybody wey e know say IDSL damage e property,e.g Fence,Building or anytin and e get better proof,make e go meet Mr Moses Ogodo or Solomon Abeke,dem go follow d person go inspect the place den pay damage so dat d person go fit repair the place on e own after dem don thru. Report reach us say Cyril Makanaki wey dey carry body like who swellow fowl,becos e buy one Bitus Camry and e dey bid badaly so that dem go nack am with Ticket Oga work,but where e for dey do nai nemesis catch up with am,as e dey among pipo wey drive Bayelsa Football Club commot from Sapele. The tin wey e dey find nai dem shook am give Eric Okosisi as d new Ticket Boss for Sapele. Report reach us say going to 1month now the people of ugberikoko road,wey dey stay close to d transformer wen dey Tuedor Junction,wey d Tranformer dey supply light,dey serious Darkness wey dey drag ground wit where Devil dey stay and Bedc nor gree go do any tin to savage the fault,and according to one guy BEDC pipo dey talk say make d area people gada money to take buy new Transformer (but i tell d guy say make e nor carry fake info becos dis sack letter itsef if na true and d Oga hear d matter) So i dey use dis update dey call on BEDC to fast go rectify the Transformer and also the Transformer wey dey UBA Fence for Court Road. From our Studio we sympertise with Efe Omas as e Mama die yesterday for the accident wey happen along warri road. All of us use white handky take cover our mouth,as we put on black up down then we kneel down dey beg God to accept her soul and grant the family the fortitude to bear the inreplacable lost of deir Mama,Hussy and Sister. Her name na Mrs Omamogho, Pastor Cletus of winners Chapel Mama. TRIBUTE TO KEFEE. Egwonor Loveth Hephzibah Irede: Who is goin to Roll eyes balls on our TV screen? who is going dance those steps of yours?who is goin to Branama for Us? We love u keffee, burr God Loves u more, Ride on , Ride on, RiDe on Heroine, Sing on Chorister,Sing on, Sing to God Your Maker. Sing on Keffe Sapele is Proud oF You , Delta State is Proud of You NIgeria is Proud of You, AFrica will always remember the foot prints You hAve Left ON Her. You are irreplaceable. Welldone AFRIca Heroine, go on, Go, go on SiNg Unto God. COUNTDOWN TO SHUTDOWN 70% UPLOADING. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 12 Jul 2014 13:15:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015