AHA! A supposed “ẹmu ooh gee” (MOG) has spoken concerning - TopicsExpress



          

AHA! A supposed “ẹmu ooh gee” (MOG) has spoken concerning brọda Jonathan’s INCOMPETENCE and his ‘Otuoke Baba and The Forty THIEVES’ style of presidency and DUST is getting seriously raised over it. Come and see peepu VEXING because the “fada” has allegedly poured sand-sand inside their garri. I’ve seen the video and I can tell you that the fada NO send anybody o. The man NO look face at all when hin dey pluck the feathers wey remain for Goodluck’s hat. He even talk sey brọda EBELE na BAD business wey dey always camouflage as AZIKIWE during election times only. In short heehn, the kind JAVELIN wey the fada throway in form of CORRECT spoke, na for Aso Rock the thing go land con turn the place to aso pebble. That said, I con dey wonder sey na wetin HAPPEN between the FADA and brọda EBELE? Because not too long ago here in 2014, this SAME fada was busy SINGING Jonathan’s PRAISES. As fada dey sing praises, na so auntie Patience dey read verses. Fada sing so tey till auntie Pashie say she dey encouraged. Oh yes I “sawd” them on video with my TWO koro-koro eyes. Fada say hin dey pray make broda AZIKIWE come back for second term because brọda ZIK na fine boy with no pimples. Fada even talk go the kidnap “childrenses” matter say na distraction because the opposition no want make brọda Jo achieve. My peepu, before you pitch tent for anybody side con dey FLIP-FLOP like this fada or dey CONFUSE like Jonathan, take a moment to THINK am well o. See enclosed video(s). Dia riz GOD o o o! KäK®™©2015°° https://youtube/watch?feature=youtube_gdata_player&v=jAN8Py7tiCo&app=desktop
Posted on: Sun, 04 Jan 2015 12:46:58 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015