AKPOR WROTE AT A PROMOTION INTERVIEW: WRITE THE 3 “TIERS” OF - TopicsExpress



          

AKPOR WROTE AT A PROMOTION INTERVIEW: WRITE THE 3 “TIERS” OF GOVERNMENT IN NIGERIA: BEFORE I go on to answer the question let me first of all ask of your health and pikin dem. As for d 3 “TIERS” of Govt. for Nigeria, Nigeria don tear finish, no be small. Even as I am writing this exam Nigeria is TEARING in Rivers State, Yobe and Bornu. In fact Major Nzeogwu started the 1st TEAR of Govt as he tear the thing commot for Abubakr Tafawa Balewa hand. 2ndly, Gown do the 2nd tear of Govt. Murtala Muhammad (God bless his soul) come tear am again for Gowon. I have mentioned three but is good we set records right and for extra mark (I beg you), then, Dimka carry wahala come tear Govt again but OSHULEGUN OSAJAMBO collect the tear wey Dimka tear. Buhari tear am again for Shagari, Babangida tear Govt. again for Buhari hand. Abacha tear am again for Shonekan, Abdulsalami Abubakar come say the tear don too much e carry all the tear-tear join am give Oshulegun Osajambo, na him every where de scatter-scatter! Infact Niaja don tear finish haba! 3 tears too small, the tear don pass to count. PDP, APGA, ANPP, CPC, AD, AC. Even sef as we de write this exam I hear say dem don tear CPC, ACN, ANPP, and APGA come give am APC.
Posted on: Wed, 17 Jul 2013 09:48:45 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015