AKPOS AND WAEC EXAMINATION WAEC examination, Akpos was asked to - TopicsExpress



          

AKPOS AND WAEC EXAMINATION WAEC examination, Akpos was asked to complete thefollowing: 1) He who fights n run away? Akpos: e don surrender be dat na, na fear catch am.? 2) A rolling stone? Akpos: No fit just dey roll, na person push am.? ...3) He who lives in a glass house? Akpos: Na rich politician e go be.? 4) A stitch in time? Akpos: dey prevent further tear tear.? 5) Birds of d same feather? Akpos: Na d same mama born them.? 6) One good turn? Akpos: Na correct power steering fit do am.? 7) A bird in hand? Akpos: Wetin e wan be again if nobe barbeque. Dem plenty for chicken republic.? 8) Half bread is better than? Akpos: Puff puff, buns or garri without sugar.? 9) A journey of a thousand miles? Akpos: Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or aeroplane jeje?? 10) He who laughs last? Akpos: Get brain problem. Make dem examine am becos na begining of madness be dat.? 11) A patient dog? Akpos: Na hunger go kill am.? 12) All work and no play? Akpos: Na bank job be dat bros.? 13) Once beaten? Akpos: Naa revenge go follow b dat.? 14) A fool at forty? Akpos: U never see Naija own, ours starts @ 50.? 15) A friend in need? Akpos: Na parasite b dat. (16) Slow and steady... Akpos: walahi na last u go carry
Posted on: Wed, 10 Jul 2013 08:30:20 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015