AKPOS LAUGH TIME!!! E get one particular restaurant wey i dey - TopicsExpress



          

AKPOS LAUGH TIME!!! E get one particular restaurant wey i dey chop for GRA, E get one oyibo wey dey always come chop there too.. Anytime this oyinbo chop finish he go shout Hey, so I wonder wetin dey make am shout, i decide to chop wetin d oyinbo dey always chop so maybe me self go shout too.. when i reach the restaurant last week friday, i order wetin the man dey chop.. Dem tell me say na chicken &red wine, so i chop am, but i no shout, i collect extra plate, but i stil no shout.. Na then i just vex ask for my bill. The waiter tell me say one plate of chicken &red wine nah N75,000 then d xtra plate na another N75,000... Na then i shout hey hey Hey Hey. I still dey shout till now.. :D
Posted on: Sun, 20 Apr 2014 17:56:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015