AKPOS LETTER TO PRESIDENT JONATHAN ON ASUU STRIKE Oga - TopicsExpress



          

AKPOS LETTER TO PRESIDENT JONATHAN ON ASUU STRIKE Oga president, First of all I hail ooo! I no say u no dey cary last. You be confirm warri pikin. But ur middle name Ebele means mercy and make u pity ur children settle their lecturers naa! The matter neva tire u? Suppose say ur pikin wey u born for belle follow us dey house, Sheeh you for never answer our we lecturers them? Una say make we bone kidnapping, militant things and all the bad bad things go enter school, now now na una com dey f**k up. All the things wey them lecturers don teash us for klass we don forget am finish. Last last, na una go still call us "half-baked", "half-roasted",abi na "half-fried". Na una sabi. Them talk say person no fit run pass him shadow. We go dey lasgidi dey for you. Na ur time be dis use am well, but we go catch you for 2015. U don forget say youths na we dey vote pass. Na we too dey snatch ballot box, dey do rally and som kain kukere things them wey them dey take win election. U go still nid our help. Na den we go show u o
Posted on: Sat, 05 Oct 2013 20:30:41 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015