AMEBO ZONE: - My husband carry my fone wen I dey sleep and em come - TopicsExpress



          

AMEBO ZONE: - My husband carry my fone wen I dey sleep and em come copy one of my friend’s number. And him dey always appreciate dis my friend anytime wey she come around and dat my friend neva marry. After I discover say em don begin talk with her and my friend don dey reduce the way she dey visit me, I come investigate am well well wen I discover say dem don begin talk for my back and my friend no tell me, I come confront my husband, em come tell me say na just to check on her na em make wey him copy her numba from ma fone and him say if im ask me I for no give am her number. But rumour now be say my friend get belle dats why she no dey comot like before again and according to wetin I still dey hear, dem say e be like say na my husband dey responsible and my husband don begin behave somehow. Him no dey come haus quick again and sometimes him no dey pick ma calls if I call am and dis kain tin no dey happen before. But as for d rumour, i neva get any evidence to prove say na my husband dey responsible for the pregnancy. Abeg make una help me o, e go dey wrong if i ask my husband who dey responsible abi wetin make i do? LadyG (@ladygdgenius) and Oche D’king (@ochewazobia) dey pon d yard. #KuleleZone #AmeboZone Tel: 0709-2222-995 Twitter: @WazobiaFMAbuja wazobiafm/abuja995
Posted on: Wed, 18 Jun 2014 16:02:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015