ASUP STRIKE ADVERTISEMENT!! Hehehe!Yes O! E don happen again - TopicsExpress



          

ASUP STRIKE ADVERTISEMENT!! Hehehe!Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association wit Chukwuemeka Pictures present anoda ogbonge movie ASUP STRIKE 2013/2014.Dis one na movie wey pass movie o! Dem no dey tell person dis one o! U must to watch am by urself & for urself. Come hear the true story behind the whole ASUP Strike. Who start am, why dem start am, who suppose end am and who no gree end am! U go c all for dis movie. Money don scatter our country o! Dis one dey ask 4 money, dat one say no money...ewoOooo o! Chai! Come see as polytechnic students dey suffer, see as crime don dey increase, girls dey born like fowl, yahoo boys dey press control enter ooo, see as lecturers kukuma don turn home teachers & some dey roger kabukabu with dem moto... Parents dey cry say their children don finish food for house. Ew ..see this mama she say na 4 derica of rice she dey chop per month but now wey her pikin dey house, nah 1 bag per month ooo...chai! See Blood!See Blood!!See Blood!!! Students no gree ooo. Rich men no worry. Leaders no even send.Ewooooooo! Wetin poor man go do. Kai! ASUP STRIKE! ASUP STRIKE!! ASUP STRIKE 2013/2014!! Full of Suspense, intrigues, romance, swagger, ginger...dat will keep u glued to d edge of ur seat. U go laff, u go cry and u go reason sef. ASUP STRIKE! ASUP STRIKE!! ASUP STRIKE 2013/2014!!!. . . Grab ur copy now! Starring: Kanayo O. Kanayo as Goodluck Jonathan, Pete Edochie as Nassir faggie, Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo- Iweala, Eucharia Anunobi as Prof.Ruqayyat, Jide Kosoko as Gabriel Suswan, Olu Jacobs as Prof Julius Okojie, Jim Iyke as Yahoo boy, Saka as poor man o! Marketed and distributed nationwide by chiemelie&Sons Ltd. 51 iweka road onitsha,and 1/3 pound road Aba. ASUP STRIKE 2013! Grab ur copy now!!!... na jst season 1 be ds o.
Posted on: Wed, 12 Mar 2014 15:23:52 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015