AUCHIPOLY TAFIA DAILY NEWS #UNA_GOOD_MORNING OOO Monday 12th - TopicsExpress



          

AUCHIPOLY TAFIA DAILY NEWS #UNA_GOOD_MORNING OOO Monday 12th January 2015 Follow Our Post Here auchipolytafia.tk to Follow Up all Our Update Our News both Old and New,, just Log in d site, dats all 12th Janury 2015 *****BREAKING NEWS ***** who get ear make e hear, SPAT form stil de on sale as screening go start soon E don come to Ur Notice say for Facebook Group, If person ask Questions, na people wey dia head block dey always Comment, Imagine make somebody ask say SpAT Form still dey on sale and 4Idiots go reply NO,,, if una no dey sure Y nt keep Shut??? HND supplementary list don dey fall out small small as Management wan release small REGULAR ND batch for HOD offices, na small sha dem go release Houses wey dey Close to School don nearly finish as New Student don Overtake everywhere. 7 days to go for School to Resume 1st Semester 2015/2016 academic Session as far me the Founder of TAFIA don finish 4 Auchi poly, na NYSC remain for me,,, GOD BLESS MY HUSTLE.... To all JAMBITES, We qet who wan helP Una for JAMB CBT 2015/2015 RUNZ,, we go Arrange the Answers for one Locked Page for Our Website, so for U to OPen am U need PASSKEY... Una go get this PassKey based on SubscriPtion,,, call 08104854272 for Ur Own PassKey. If U get wetin U wan Advertise, maybe na Ur ComPany of Profession, we don start dey Post advert for Our Website, we dey Use Image or Text Advert,, Ur Advert go rePlace dat shine uP Nigeria wey dey Our First Page and we go also HelP U Market Ur Stuff Wella. We dey Even advertise Music or Video... #Na #Otaru of Auchi Talk am..... Some Bad tinx don Start dey Happen for Auchi now, all this Soldiers wey dey Come in dey Bully people anyhow, Na Yesterday One Soldier give bike am Frog-Jump for Front of Iyekhei Girls school just becos the Man Overtake am... The ICT BUILDING wey dem don almost complete, Managent wan Commision am February and this Time, Oshio-Baba go come... -------CLEARANCE FOR OUR bros nd sist dem wen GRAJ last YEAR don START ooo.. ----CLEARANCE for our spatacus freshess go start dis week, I never dey Sure if na today E go start. SPAT 2Nd batch loading 88%, If U buY SPAT form and U nor see Ur Name,, call 08104854272....... Our Dean of Student affairs say make I welcome both Old and New Studnt Back on CampUs and e dey wish Una stress Free Semester ooo...... our morning students both old nd young go resume on the 19th of this month.. While spat na 19th also, as the Circular wey just com Out be say REGULAR AND SES go resume 19th.. Campus 3 Buildinq still dey in progress... NYSC aspirants, dem don postpone d collection of Call-up-Letter and Service till March bcos of Election... This tin dey Vex me ooo bcos e dey delay me... SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 SPATACUS ND1, HND1 sch fees»38,500+bank comm ND2, NDF, HND2, HNDF sch fees»28,500+bank comm I beg make una pay una school fees by una self oo, if u carry am give person make e help u pay, anytin u see make u take am like dat SHOUT OUT TO * 9ICE * TESTIMONI * BETA pIKIN * MC M LECTURER * GIDEON * WApJUNIOR * RAMBO and Not For getin my Man, MC OKponkwu da Chinesse Man, My Dean of Student Affairs,, I GREET UNA BANK ACCOUNT... #GOD #BLESS Does of una wen go like come out for SUG, CLASS REP/ DEPARTMENTAL Post, make una inbox us o, cos we go fit make una acheive una dreams.. Na here I go Follow end my Ogbonge News, If U need Our HelP on any Issue, Just Telewaya Us on 08104854272 Na me be D OTARU OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY D MOUTHPIST OF AUCHIPOLY D TATAFO OF AUCHIPOLY Na im dey nack Una dis News,, abeg make I go Bath enta Ugbowo, Una Bye Bye
Posted on: Mon, 12 Jan 2015 06:26:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015