Abeg Ijaw make ona enjoy d fruit of Ona labour all these noise of - TopicsExpress



          

Abeg Ijaw make ona enjoy d fruit of Ona labour all these noise of Isoko Deputy don dey make ear pain me,the SsG wen we dey for 8years wetin Macauley use am do?..who e take am help apart from Odio wen e give media aide abi pa abi wetin I nor even know,Our so called leaders should be ashamed of themselves,if we fight dis fight dem come get deputy governor wetin e go bring to us,nothing nothing nothing,e good make we lose everything so that next time we go dey stand our ground..must we even die in PDP in Isoko the Opposition is there but we say na PDP we go die put and nothing dis PdP don give to us apart frm same old block wen they enrich dem pocket..make I hear word abeg Why Isoko man nor buy governorship or senatorial form? Make we suffer for d next eight years,governor say governor say,person nor go hear word for isoko
Posted on: Fri, 19 Dec 2014 05:32:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015