Abeg e get dis particular restaurant wey i dey chop for wuse 4 - TopicsExpress



          

Abeg e get dis particular restaurant wey i dey chop for wuse 4 Abj. E get one oyibo wey dey always come chop there too. Any time dis oyibo chop finish him go shout "heey!", wetin dey make am shout nobodi knows. So one dai i decide to chop wetin di oyibo dey always chop so maybe me self go shout too. When i reach d restaurant last week friday i order wetin di man dey chop dem tell me say na chicken and red wine, so i chop am. I surprise say i no shout, i even collect 2 xtra plate but i still no shout. Na then i just vex ask 4 my bill. The waiter tel me say one plate of chicken and red wine na #45,000 then d xtra plate na another #90,000 na then i come shout heyyyyyyy! Heyyyyyyy!! Heyyyyyy!!! Heiiiiiiiii... Ma dear u no go lyk hear d rest of the stori Happi Wikends peeps
Posted on: Sat, 14 Sep 2013 08:50:40 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015