Akpors why do you Love your Country? I LOVE MAI COUNTRY Na only - TopicsExpress



          

Akpors why do you Love your Country? I LOVE MAI COUNTRY Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading #200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge #100 an win benin republic. Glo, go jus kuku say... Recharge 500 and win Nigeria bcos there colour na Green. Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE" Na only for nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey say: Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a piti)=D Na only fo Naija people dey horn for traffic light make e quick change frum Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff, Ogogoro and beer. Wetin you u no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world...
Posted on: Thu, 06 Jun 2013 09:20:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015