Akpos was driving down the street at Alausa Road, having just - TopicsExpress



          

Akpos was driving down the street at Alausa Road, having just finished answering a call when a police man suddenly opened the passenger door, entered and jammed it. As usual he wanted something from me for calling while drivin... Then suddenly he saw the big Rothweiller dog- Jackie at the back-seat with tongue stuck out, spittle dripin n fangs barring, staring fiercely at him. POLICEMAN: [Shaking] Ah! You carry dog? Akpos.: [I bone face] Yes I carry dog, that one na offense? POLICEMAN: [Feeling uncomfortable] Na where una dey come from? Akpos: From hospital POLICEMAN: Ehen! you sick? Akpos: No, na person wey the dog bite we go see,the person almost die sef POLICEMAN: [Terribly shaken by now] Ehen! but why the dog dey shake head like dat? Akpos: Na so im dey do if e wan bite person POLICEMAN: and the dog know you? Akpos: Yes nah, no be my dog? POLICEMAN: [Sweating] This your door, how you dey open am? Akpos: how you take enter? POLICEMAN: Abeg! Na since I dey try open am but e no open [The dog was now getting impatient and gave a small growl, its tongue almost touching the policemans left ear] POLICEMAN: [Now sliding forward] Oga I take God beg you, open the door for me make I comot, I no go collect anything from you Akpos: how much you go pay me? POLICE: Ah! I neva hustle anything since morning, na only 1k dey with me. Akpos: You neva ready,(attemptin to release the dog.) POLICE: ok ok ok ok ok, e reach 2k, the oda 1k na my wife own but I go give you join (now close to tears as the dog was becoming really impatient and geting ready to attack) Oga I be......g sorry for me take 2k make you open the door plsssssss Akpos: oya bring am (colects the 2k and allows him out of the car) POLICEMAN: God punish you idiot, e no go ever better for you and your yeye dog, wicked man...
Posted on: Wed, 02 Apr 2014 22:29:14 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015