Arsenal, Milan don pak load comot Arsenal waka for dis seasin - TopicsExpress



          

Arsenal, Milan don pak load comot Arsenal waka for dis seasin Champions League don kpafuka as Bayern Munich don comot dem wit 3-1 aggregate win afta dem draw 1-1 for Allianz Arena. De gunnas enta de match wit de hope say dem go try comot Bayern but e no come be as na Bayern begin dey kontrol tins dey hol ball well well. Na two times e for remain make Bayern score for de fes haf as Arjen Robben and David Alaba all test Arsenal kipa Lukas Fabianski. Bastian Schweinsteiger come chuk Bayern put for front for de 55 minut for secon haf as hin jab cross wey Franck Ribery bring come. Arsenal no kuku waste time afta de gol as dem just fire Bayern dey go as de gunnas Germany playas Lukas Podolski come ekwalise for dem wit gol wey beat Manuel Neuer siddon inside net Bayern bin still kontrol tins and dem for nearli win am for mortuari time but Thomas Mueller miss penariti wey refuree gif de Germany champion as Laurent Koscielny pak am inside eigtin, Na se same stage wey Bayern comot Arsenal las seasin sef and now de gunnas go pak load begin de go house wait for nes year. Diego Costa be de baba of day as Atletico Madrid hama AC Milan 4-1. To make am 5-1 on top aggregate to waka enta de kwatafinal for de fes time inside 17 years. De new Spain strika bin score de onli gol of de fes leg and hin kuku kontinu de parada for dia Vicente Calderon Stadium for Spain as Milan show for de secon leg. Match neva enta gear one sef wen de strika score de fes gol for de 3rd minut wit korrect sissos kik, but Brazil oga Kaka come ekwalise for Milan wit heda for de 27 minut. Ardan Turan come make am 2-1 bifor haf time reach and as secon haf show, na Atletico begin dey run tins take jolly finish de match. Na gols from Raul Garcia and Diego Costa come close market for Atletico as dem score for de 71 and 85 minut to push Milan comot from dis seasin kompitishun. Na de results from Tuesday nite be dis: Bayern Munich 1 (Schweinsteiger) Arsenal 1 (Podolski) Atletico Madrid 4 (D.Costa,(2) Turan, R.Garcia)
Posted on: Wed, 12 Mar 2014 10:33:53 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015