As Naija bin fes colet ticket to go nes year World Cup - TopicsExpress



          

As Naija bin fes colet ticket to go nes year World Cup for Brazil, na so Ivory Coast kukuma shadow dem enta, afta dem follow Senegal play 1-1 draw, to make scores for de two leg be 4-2, for inside Casablanca for Morocco on Saturday nite. Dis one go be Ivory Coast third strait World Cup, but Senegal bin put beta tenshun for dia bodi, sake of say Senegal strika, Moussa Sow bin score penarity as match jus reach 77 minit. Na Didier Drogba cause de pena, afta he foul Senegal attaka, Sadio Mane inside 18. Na so Senegal come pour petrol ontop dia faya, bicos anoda goal for carri dem reach World Cup, but Ivory Coast jus balance, do dem bad tin, wen Salomon Kalou colet ball from quick counter, go score, to make am 1-1 for inside mortuary time. Why e pain Senegal die be say, Kara Modji bin suppose score goal for dem, jus bifor Kalou score hin own. Na small remain. Meanwilly, Naija bin don show Africa road, afta dem waya Ethiopia 2-kondo for Calabar, to make scores for de two leg 4-1. Na numba five World Cup for Naija be dis. Senegal bin dey play dia match for Casablanca (inside Morocco) bicos Fifa trow red card gi dem, afta kasala bust for dia own stadium las year, wen dem bin dey follow Ivory Coast play match, and na Ivory Coast fes show diasef for dis match. Match neva even reach five minit, Ivory Coast don colet two corner. Senegal come start to show dia skill afta, and na so Idrissa Gueye faya shot from outside Ivory Coast 18, as match reach 13 minit, but de tin go ova de bar. As match reach 18 minit, Ivory Coast goalie, Boubacar Barry, jus carri hand push one kin free kick comot, as Senegal jus dey press dem. Meanwilly, Roma strika, Gervinho, bin dey show hinsef for de match, as he jus dey dribbu Senegal playas anyhow. Wen match reach 34 minit, na so Senegal strika, Papis Cisse, nack one sharp, sharp shot, but Ivory Coast goalie, Boubacar Barry jus laff, catch am. Yaya Toure for score Ivory Coast fes goal, as match reach 42 minit, but as he fin way enta 18, tia shot, na so Senegal defenda block am. Sadio Mane for helep Senegal score goal wen match enta 63 minit, but he faya shot ova de bar. Afta Senegal come score dia penarity, na so dem come dey press Ivory Coast, bicos anoda goal for carri dem enta Brazil, but de tin no gree enta net. For Naija, Victor Moses fes do Ethiopia bad tin, wen hin faya penarity enta net, as match reach 20 minit. Na Ethiopia defenda, Anyalem Hailu carri hand touch ball inside 18. Obinna Nsofor come enta match for second haf, nack one helele free kick, as match reach 82 minit. De ball fly enta net strait. Na dia match finish. Na Naija be Africa Champion, and na so dem dey show Africa road sef, as dem go play dia numba five World Cup nes year. Naija bin play for 1994, 1998, 2002 and 2010. Na 15 tausan pipu pack diasef enta UJ Esuene Stadium for Calabar, watch dat match, but de Supa Eagus no too tap beta ball o! Until Obinna Nsofor goal, Ethiopia still dey show diasef. CSKA attaka, Ahmed Musa tok say hin belle sweet am, as hin go play hin fes World Cup so, but na de heat for Calabar slow dem down. Na onli Baba God we tank o! I don dey drim World Cup since, and e don hapun, na im Musa yarn. We for tap pass dis one, but as everiwia hot so, de tin jus slow our ball. Celtic defenda, Efe Ambrose, tok say hin dey pray say Naija go show diasef for Brazil. Belle too sweet me say I follow dey dis kin tin. Now na to helep Naija do well for Brazil. Na Efe for fes score Naija goal sef, as match jus start, but Ethiopia goalie, Sisay Bancha, keep faya. Na one hand de guyman take save shot wey Emmanuel Emenike faya sef, as Naija dey fin dia fes goal. Ethiopia sef show say no be akara dem come fry, as Saladin Said faya shot wey jus waka pass front of Naija goal. Victor Moses come tell Naija,chillax as he faya penarity enta net, afta refree tok say Hailu carri hand touch ball inside 18. Ethiopia goalie, Bancha, jus dey sell hin market, as he dive push one ogbonge shot wey Onazi faya. De ball jus bounce reach Ideye front, but de guyman faya de ball ova de bar. Ethiopia come start to tap ball for second haf, and na so dem halla refree for penarity as match reach 51 minit, but de guyman no gree, bifor Vincent Enyeama come comot ball for Shemeles Bekele leg. Ethiopia come dey play ball like winch, as match wan finish, but e be like say dia strika dem, dey on strike, and na so case come close afta Nsofor nack sat free kick enta net. © supersport
Posted on: Sun, 17 Nov 2013 22:53:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015