Auchi Poly SPAT update: *. I want to start this update by - TopicsExpress



          

Auchi Poly SPAT update: *. I want to start this update by saying a very big thank you to GENESIS NEWBREEDS for the HND admission list posted on AUCHI POLY GROUP CHAT. God bless you. * Matter Arising* *. with time we will post all admin phone numbers for beta communication, cuz no be every min we de facebook. *. Regular students are to resume 9th of this month, even if the sch no go get head I strongly advice u come on time and look for house to stay oooo! *. As for house mata, the one I know of : self con is 65,000 for single room na 50,000 and bourhole(water) de d house, security is 99.9% de fence am round the house come de in between campus one and two, e near the school hostel. *. Abeg I put my two legs for ground: if any admin for this group no run admission for u, abeg no de complain for we page say u give person money and ur name never come out. Make those with simple mind no come de think d oda way. As for admission mata we de admins go try help incoming candidates for next year admission mata. And for spat students we de una back o. *. Dem say if u put ur eye and ear for ground u go hear and see many things dat na wetin we student of mass comm are trained to do... well I de one big oga office wan submit my file, na I hear dem de say even if u score 80 or 70 for CBT test and Jamb na 200 ur name no go come out if u no do follow up, because ur name oga dem fit remove am. *. Rumour de fly up and down, I wonder how people wen de Abuja , Lagos etc de get information faster dan we wen de d sch... 3rd batch never come out for ND ooo! And another lie wen I still hear be say 3rd batch Na for people wen buy change of course form this one no be true oo, d form na to boost ur chance no b automatic admission ooo. *. Hmmmm... ND one : this na sad story wen no good for belle at all cuz I just de sad: well information. Reach me yesterday say one ND1 student go carry to cetificate go house one na school own the oda na hospital sake of say she don carry belle. The most painful part be say; her parents rent self contain for her she go de stay with boy for single room, dis boy never fit feed himself finish oo e de carry babe , de chop de girl money and de chop her tins join. My advice be say: I will never tell not to date someone in sch , (even me wen I de here de look for babe too o), but make Una de use una brain well, like my economic techer de tell us girlfriend n boyfriend is a good tin, but its not something u carry on ur head. if cold kash u condom is der for u, or use withdrawer method. Make una shine una eye ooo mama and papa no de school ooo its a wild wild world here ooo. *. As for 3rd batch, it may not come out on time due to the ongoing sell of change of course form make una jeje oo e go come out. *. Make una no vex ooo, but d truth be say , e be like say the new intake neva ready to come sch o, bcus dem no even de look for house to stay. Well na here our group update go end: group update de come out any time and na base on questions wen una de ask we admins na we take de build up this update. Una take care.
Posted on: Mon, 03 Nov 2014 08:47:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015