Backpass, January 19 Mede Mede My people, we hail una ooo. - TopicsExpress



          

Backpass, January 19 Mede Mede My people, we hail una ooo. How una dey, ehn..we dey jolificate today ontop say the President-General Pidgiology worldwide, Totori Master dey do byday today. So de tin wen I carry come so na as we take nack am giv u for weekend oo...Football Live, dat ogbonge package wey we for sports radio dey nack una as we oyinbo reporters dem go dey all match venues dey nack una beta tori as e dey shele for field. so...na Etihad stadium de gbege shele oo...and na Arsenal kpokpo Manchester City 2-kondo. De match nor be hia ooo...de tin shock every man wey sabi and wen nor even sabi ball sef. Now as e dey, na 5 points Chelsea dey take lead City. Deliberation: You tink say Arsenal na serious title contenders with dat win & shey Man. City still fit retain de title?
Posted on: Mon, 19 Jan 2015 07:35:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015