Bayern don open better gap: Bayern Munich fit grab de crown for - TopicsExpress



          

Bayern don open better gap: Bayern Munich fit grab de crown for Bundesliga champions ness wikend afta dia 2-1 win for home against Bayer Leverkusen on Saturday wey don keep dem 23 points clear for table. . Dem go confirm de European champions as German champions for de 24th time if dey win Mainz ness saturday and also if rivals Dortmund and Schalke kon draw. Na goals from Mario Mandzukic and Bastian Schweinsteiger helep Bayern dey jolly dia 17th-straight league win and kon extend dia record for unbeaten Bundesliga run to 50 matches. Former Germany striker Stefan Kiessling helep waya one goal for Leverkusen wen hin head ball inside net befor de final whistle. We go be champions, but we need to kolet small points fess, naso pep Guardiola yarn. De koko be say make we juss dey tap betta ball, wen. E go hapin no matta sam sam. plenty wahala follow dia win for back for Bayern tori afta former presido Uli Hoeness don resign for Friday, 24 hours afta dey don convict am for tax mago-mago and jubiti. Na three and haf years Munichs regional court sentence am for de cheat wey hin do de state for de €28.5 million wey be taxes hin no pay. Leverkusen be de lass German team wey beat Bayern back for October 2012, but Sami Hyypias side juss try to stop dem but kon suffa dia seventh defeat for eight matches. Dey don already drop to fourth place afta Schalke wey bulala Augsburg 2-1 on Friday wen Dutch striker Klaas Jan Huntelaar waya de two goals don occupy de third place. De win don ginger Schalke wey go waka on Tuesday to germ Real Madrid wia dem go face plenty wahala to cancell dia 6-1 home leg defeat. De thing wey also helep Bayern to dey go close to anoda title now be de kain 2-1 defeat wey secon placed Borussia Dortmund kon suffa for home to Borussia Moenchengladbach on Saturday. Gladbach wey grab dia fess win for ten games don dabaru de confide wey Dortmund get befor dia Wednesdays Champions League lass 16 match for home to Zenit St Petersburg wen dey hold a 4-2 lead from de fess led. Dortmund now juss take one point dey top de third placed rival schalke befor de Ruhr Valley derby on March 25 Swiss coachi Lucien Favre don extend hin Gladbach kontrak till 2017 and hin side bin waya two goals for nine-fess haf minites for Dortmunds Westfalenstadion. Mainz don waka up to fifth place as dem carry style waya Hoffenheim 4-2, de win still make thomas Tuchels Mainz dey look for European spot ness season and dem dey three points short of Champions League spot. Vfb Stuttgart wey wan face relegation with dia new coachi Huub Stevens wey dey incharge, neva win any match for dia lass 10 games as na 1-1 draw dem play with Werder Bremen. Wolfsburg don drop to sixth afta dem play 1-1 draw at bottom side Eintracht Braunschweig as only three points bin seperate de bottom four clubs wey include Freiburg, Hamburg, and Stuttgart. Hertha wey dey eye European spot bin suffa a set back as dem loss 2-kondo for home to Hanover 96 to settle for ninth place and four points away from de top six.
Posted on: Mon, 17 Mar 2014 13:23:11 +0000

Trending Topics



le="min-height:30px;">
Chapter 11: The theme is based upon the fact that oppressive
Purchase Nike Boys Grade School Air Max Stutter Step Basketball
Here are all my Film and TV production industry credits as well as
CXRacing Damper CoilOver Suspension Kit For 00-02 HONDA Civic ES
#BADMINTON Luarbiasa! Vita Marissa Raih 2 Gelar di Amerika Grand
Kawasaki 840062 Green 14.4-Volt Cordless 1/2-Inch Impact
Israeli Air force NASTY SURPRISE for Iran military Another great
Pasuma Signs First Artiste, Frankie Free on Wasbar Records Posted
O dragão na imagem de São Jorge representa o demônio, o mal que

Recently Viewed Topics




© 2015