Before u dey use bb dey buga!... now everybody don get bb, Before - TopicsExpress



          

Before u dey use bb dey buga!... now everybody don get bb, Before u go dey use ur camry dey buga!..nw boys don dey use am do cab, B4 u dey use ur plasma screen dey swell.... now dem don dey use am watch ball for buka, B4 u dey use ur ipad dey swag... now ipad na heavy load to carry commot 4house, B4 u go dey use brazillian hair dey form big... now secondary skul student don dey wear am troway, B4 u dey go vacation 4 uk dey talk pass urself... now boys don dey buy 1st class ticket dey enta london jus to go lick ice cream, Bottom line...no dey over do like say dat tin no go reach anoda person hand,All na vanity,e dey fade like Aba Jean. nor 4get say tortoise car na big man motor b4 o... Notin wey come wey nor get expiring date, even the life you have na borrow you borrow am. Humility na the best choice....sha na wetin I get †Φ tell b dat..make wuna flex sunday gently oo
Posted on: Sun, 15 Sep 2013 10:49:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015