Ben Markson Wrote I dey come back from somewhere this - TopicsExpress



          

Ben Markson Wrote I dey come back from somewhere this evening, almost near my house oh, i come see one of my Guy wey beg me to see am off to the busstop but on getting to the busstop naso i see one new SUV Jeep just park for our front , and one clean beautiful girl come out from the SUV come start to dey cry,before i know wetin dey happen. naso she rush go kneel down, dey beg one slim bobo wen be like say him never chop for months, the babe just dey beg dey cry dey follow the guy dey tell am say she no need money, she no need brazilian wigs, she no want shoes, house or anything, she say she no even need the SUV jeep self, all she want na im love, his kisses and his warm embrace, the babe just dey shout dey cry, the thing wey come touch my heart na when she come tell the bobo say She no care to buy him a car as a sign of her undyeing love, even come promise to give the guy the 500k wey im be ask for, when i hear those words eh, my heart come stop to dey beat, naso my head come spark and my brain burst, i come dey wish say this babe na my own o. The guy no even dey look the babe self, he just dey shout say make the babe leave am alone, na then me come vex say if this guy no know the value of this girl, well right now eh, me i don fall in love be that o, so make i go claim this girl by all means but as i near there... . . ....one man just touch me for back say oboy abeg no block the camera. Rubbish! na even NOLLYWOOD film dem dey shoot??? ...when i don already fall in love, abi this kind love no dey exist?? ......mchewwww
Posted on: Wed, 05 Nov 2014 17:50:31 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015