Blackberry don chop my money tire,na hin I come vex yestaday sell - TopicsExpress



          

Blackberry don chop my money tire,na hin I come vex yestaday sell am, come take some money buy China phone! Now am in bigger trouble!!! 1, E go full after 3 minutes of charging. 2, The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Fire lighter etc. 3, I fit write Text message with a toothpick sef. 4, The spelling get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-Indecency, samswag etc. 5, When aeroplane pass e go record "One missed Call". 6, When a big truck horn; e go show "Charger connected" 7, When Chinese man pass e go show: One Bluetooth device found" 8, When ugly man. waka pass, e go show, "Virus detected" Abeg I wan sell am! Who wan buy ooo? Even as I dey find buyer, e dey show me for screen: "No contact found"!!
Posted on: Thu, 01 Aug 2013 09:52:01 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015