Brief news: Late senator Ewerido death don put another rat race - TopicsExpress



          

Brief news: Late senator Ewerido death don put another rat race for Delta central senatorial district. Tory reach our table say, Hon. Agoda, Hon. Ighoyota Amori, E. Edafinone plus other person wey e drag am before don prepared gidigba to replace the late senator Ewerido. The question nah be say, DPP go fit replace them lost office or PDP go fit win Delta central? Make we pend am till result judgement day. Tory reach us from Oghara, Ethiope west local Government area say, dem don release one Hon. Ighomena, wey dem kidnap for time ago. When our Apploko team reach the compand of this former commissioner, former house of assembly member and present state PDP vice chairman, him followers dey dance rejoice for the release of them oga, out of the hand of kidnappers, Apploko team drink many many bottles of beer, and many henesen. Tory reach us from Jesse say, those transformers wey Apploko tell una don come to reality. Many person doubt Apploko that time say, we dey carry dey praise the present transition chairman Hon. Precious Ajaino. Person like Fred and Magold nah one of them. Tory reach us say up till now, them never switch any one on. I want to call on Hon. John Nani, wey e supply four out of the five and Hon Jude Fregene wey e supply the last one, make them make sure say, them supply brand new transformer, and not painted ones, because both of una come from Jesse. And Jesse people say, make una bare in mind say, if na cantafit or inferior una supply, both of una names go become inferior for Jesse for ever, and not only that, nah e be say, nah una dey draw Jesse back, because nor be una money buy am. Apploko want still advice una to huge NEPA make them put am in order quick quick make those wey e don dey surfer for light now for the past three years now (3yrs) get light. I beg, make we fly to mosogar for fresh Apploko. Come rain come sun, Ethiope much progress....
Posted on: Tue, 30 Jul 2013 09:58:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015