CONVERSATION BETWEEN Akpos AND A RAT. . . RAT: (with tiny - TopicsExpress



          

CONVERSATION BETWEEN Akpos AND A RAT. . . RAT: (with tiny voice) hello Akpos: hello,who am i speaking wit? RAT: na Mr Akpos be dis abi? Akpos: yes u are speaking wit Mr Akpos, who is dis pls? RAT: so u no recognize my voice abi? Na me ur room mate. Akpos: u say what?. RAT: ur room mate Rat. I dey ur room now.. Akpos: i beg ur pardon? RAT: which yeye beg u dey beg.i never chop since yesterday wey u waka comot. I check that place wey u dey put food i no see anything. I check d kitchen nothing. I even check ur fridge no single food there. E be like say u wan kill me abi.. No problem, i jux say make i let u know say that ur certificate 4 inside your wardrobe wey dem write LAGOS STATE UNIVERSITY, i don eat d LA comot. RemainingGOS STATE UNIVERSITY. Let me see which work u go take GOS state university find. ...(rat ends call)
Posted on: Thu, 13 Feb 2014 11:56:21 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015