Chai...... Because Of Ebola Virus!!! Guys dey now fear to shake - TopicsExpress



          

Chai...... Because Of Ebola Virus!!! Guys dey now fear to shake their fellow guys, instead, dem go just throw way salute like person wey newly join soldier. (Na their fault?) Pipo dey now wear long sleeves sweaters, headcovers, and trousers while entering buses and taxi no matter how hot the weather b (See as Ebola just turn Naija to europe) Neighbours, even family members dey now suspect 1 another at the slightest sign of illness, my neighbour even go call health officers for me just because say him see me sneeze 2 times today (person no fit get cater again?. You take a girl out for dinner, drives her back to her house, walk her to the door-step, she leaves you, walks into her house, open d window, waves at you and throw a goodnight kiss at you (if you like catch am). D aboki wey dey sell suya near my hux, dey chop him suya by himself bcus nobody gree buy suya again (even d suya sef na suspect) Nigeria Police no dey arrest Person again o, if You commit any crime, just do the arresting by Yourself. Handcuff urself by urself come station, use ur hand by urself enter cell (even police no wan die) My friend don dump him girlfriend just bcus her name na BOLA........ Bola don even change her name to TOLA....... But my friend say as far as theres OLA in d name, It Is over Between him & her!! (U can imagine) I see where 1 Igbo man dey greet him neighbour say IBOLA Chi? Which is the normal way to say Good Morning in Igbo land....... But because of d BOLA wey dey inside d IBOLA, d Igbo man neighbour reply d igbo man wit a very harsh tune Bowakwa gi onu ebe ahu (so e don reach like dis?) One YORUBA woman wey dey my area dey greet me d other day say EKU EBOLA..... & I answer her say EKU BACK TO SENDER (see me see wahala o) As for me Ugo....... Na to dey dress like Spider man naim win am now o,,,,,, atleast to avoid body contact (death neva dey my agenda for now at all) Anyway, I strongly believe say God go see us thru b4 d matter worse pass dis 1 Una Good Evening
Posted on: Fri, 01 Aug 2014 21:04:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015