..Chai!.OVER 5000 STUDENTS DON HEAR AM HOT(DUPED),AS NATIVE DOCTOR - TopicsExpress



          

..Chai!.OVER 5000 STUDENTS DON HEAR AM HOT(DUPED),AS NATIVE DOCTOR OPENS UNIVERSITY Police don arrest one native doctor wey be Fidelis Chukwujindu onto say ihm don trick over 5,000 students, bin dey collect money from dem and doing fake entrance examination for pipu no sabi as ih dey go. Dem nab Fidelis for de area of ihn non-existent College Hospital wey get de sign post “University College Hospital Ogboko, Ideato, P.O.Box 1960, Orlu, Imo State. Dem also write for de signpost “Present Courses: B.Sc, Nursing, Health Sciences, Education Humanities, Medical LAB Sciences. Admissions still dey go On. Govt. Approved. Call: 08064082750.” De operator of de illegal college attract students by de flyers wey dem print and dem dey distribute to churches across de countri, as most of de students claim say dem know about de school through dem pastors. Fidelis claim say ihm don get permission from de State Government and Federal Ministry of Education to run ihn fake college hospital. Ihn also claim to be product of de Ogbonge Harvard University, America. “I win de Federal Government scholarship to study abroad, but accident disfigure one of my legs na so I fly come back to Naija where I later decide to set up de college,” Ngozi Ayoha one middle aged woman wey dey assist de suspect, wey claim to be de vice –chancellor of the university college hospital. Before, de woman yan say she deaf and dumb, kasala con burst wen dem find out say she be de Dean of Faculty of Medicine of de illegal college. As dem de carry de suspect up an down with ihm victims infront of Newsmen, , Mr. Muhammad Katsina, wey be de Commissioner of Police explain say one tricky thing about the mode of suspect be say dem chose de site wey dey opposite de Imo State University, Ogboko, and near de Rochas Foundation College, Ogboko, to make ihm victims believe say na coret business. Na wa o… Oyibo man go talk say everyday for de thief one day for de owner.. Ih get as ih be oo *OGBONGE NAIJA* Follow on twitter @OgbongeNaija
Posted on: Sun, 08 Sep 2013 21:33:42 +0000

Trending Topics



ight:30px;"> Lafayette 148 New York \Shonda\ Matte Silk Blouse #If you are
I Continue to ask for help from everyone plz. Odus is still
First there was Bitcoin...now there is ILCoin! Ilgamos is
When will they ever stop buggin me with these stupid inboxes >>>>>

Recently Viewed Topics




© 2015