Chelsea go waka reach Crystal Palace on Saturday, as de - TopicsExpress



          

Chelsea go waka reach Crystal Palace on Saturday, as de two London area club go wear one trousa, wen England Premier League start again dis weekend. Crystal Palace bin shock all man las season, wen dem waya Chelsea for dis match, na im make Chelsea skippo, John Terry no gree follow pipu wey dey yarn say Chelsea don alredi be champion dis season. How na? Season neva finish sef, na im Terry tok. Oda club don dey dis level bifor. E sweet to gap all man, but if your mango tree big pass evribodi own, all man go wan pluck am. Na wetin make Premier League sweet. All man dey plan us sake of say na we dey numba one and we dey tap coret ball. Na Manchester City be defending champion, but dem dey shadow Chelsea from second position, as dem go break kola, wait for Tottenham Hotspur. City midfilda, Frank Lampard (na borrow, dem borrow am from America league club), don dey draw ear for hin team mate dem. Spurs neva too get diasef now, but I bin like dia coachi, Mauricio Pochettino, wen hin bin dey coach Southampton. If hin carri dat Southampton format enta Tottenham, dem go worry. Meanwilly, de tori wey dey surprise all man, na de way Southampton dey tap ball dis season. Even tho dia coachi waka comot, plus many of dia ogbonge playas, dia new coachi, Ronald Koeman be like persin wey dey use juju, sake of say dem tanda for third ontop league table. Na Sunderland dem go follow play on Saturday. Koeman don dey helep Southampton tap helele ball sotay, many guymen dey voke say na hin suppose be Holland coachi sef, sake of say dose ones don troway two match, out of de three carri go Euro 2016 match wey dem don play now. For Koeman side, Holland troway dia chance wen dem carri de coachi work give Guus Hiddink, afta Louis van Gaal waka go coach Manchester United, afta World Cup. I sine paper wit Southampton and I no dey plan comot. But futbal dey one kin sha. Na Southampton get me now. Wen I fes waka comot Feyenoord as coachi, my eye bin dey ontop dat Holland work, but dem choose Hiddink insted. Arsenal go follow Hull City play dis weekend, as many guymen dey rememba say na two of dem play FA Cup final las season. Hull bin dey lead 2-kondo dat time, but Arsenal wake up, waya dem 3-2 to win dia fes Cup since nine years. Burnley jus enta Premier League dis season, but to win match hard dem. Newcastle sef, dey hear am, but de two of dem go play West Ham and Leicester for house, on Saturday. Nobodi own worwor reach QPR sha, as na dem dey bottom table. Liverpool go waka reach dia house on Sunday. Tori wey full ground be say; Tony Fernandes, wey get de club, fit troway dia coachi, Harry Redknapp. But QPR defenda, Rio Ferdinand (Redknapp don coach am bifor, wen hin fes dey West Ham), tok say make Fernandes cool down small. Season neva go anywia, na im Ferdinand yarn. If dat kin tin hapun now, e no go pure. Redknapp na paale wey get gree-die well well. Afta dia worwor futbal, Manchester United don tanda for fourth position now. Dem go wan stay dia, wen dem waka go follow West Bromwich Albion on Monday nite.
Posted on: Sat, 18 Oct 2014 21:06:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015