Conversation between a Rat and Man(Akpors).... Rat: (with tiny - TopicsExpress



          

Conversation between a Rat and Man(Akpors).... Rat: (with tiny voice) hello. Akpors: hello, who am i speaking wit? Rat: na Mr Akpors be dis abi? Akpors: yes u are speaking wit Mr Akpors, who is dis pls? Rat: so u no recognize my voice abi? Na me ur room mate. Akpors: u say what?. Rat: ur room mate Rat. I dey ur room now.. Akpors: i beg ur pardon? Rat: which yeye beg u dey beg. i never chop since yesterday wey u waka comot. I check that place wey u dey put food i no see anything. I check d kitchen, nothing. I even check ur fridge no single food there. E be like say u wan kili me abi.. No problem, i jux say make i let u know say that ur certificate 4 inside ur wardrobe wey dem write LAGOS STATE UNIVERSITY i don eat d "LA" comot. Remaining "GOS" STATE UNIVERSITY. Let me see which work u go take "GOS" state university find. ...(rat ends call)..... *PriNCe_hoRLaR*
Posted on: Sat, 24 Aug 2013 21:48:35 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015