Countri piple na beta tori I wan nak una sooo! E get time wey lyf - TopicsExpress



          

Countri piple na beta tori I wan nak una sooo! E get time wey lyf b no dey as e dey soo. Una knw wetin bring us com wie we dey nau? Na pipl wey no gri sey evrytin wey dey shine shine no b gold! I dey provoke wen I dey luk contrime n and wimen dey do wetin dey mek dia felo contriman dey cry. D koko b say som neva knw hw lyf fit turn dem. Naim mek I say mek I gist U smal. D trut wey dey d tori b sey wen u don hozle dis plenti tinz finish...dem go gada tel u say na dust wey u frm, na dust wey u go go yonder! Chai, d pesn wey im own go pain me pass na person wey sun, rain, hamattarn hama finish com go yonder e com b say na HELL!!! My contri pipl d only lif wey u fit liv na d one wey baba God dey giv us thru im son Jesu christi. Mek I ask u sef, U and dis im son don bcom friend b4? If na NO, tel am mek im com tek ova ur lif and I tel U, Jesu Christi no fit fall ur hand!!!
Posted on: Tue, 22 Oct 2013 11:12:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015