Cristiano Ronaldo pikin Cris na correct fans of Lionel Messi afta - TopicsExpress



          

Cristiano Ronaldo pikin Cris na correct fans of Lionel Messi afta hin and de Argentina kaptin jam for Zurich for de Fifa Ballon DOr wey bin shele las Monday wey pass. Afta dem name Ronaldo as de winna of de Ballon DOr and na Messi wey don win am four times come second, de two of dem come jam for de lobby side for Zurich Kongreehaus begin yarn. Na dat time Ronaldo pikin Cris come point hand gif Messi run go greet am. Ronaldo sef come kuku tel Messi say Hn bin watch one video like dat for internet wey all of us dey and na you hin come dey gbadun,Ronaldo tel Messi as hin pikin cme dey do like say hin dey shy. Barcelona strika Messi come smile gif am come ask Ronaldo pikin how hin dey. See as you dey do dey now,Ronaldo come tel hin pikin. Ronaldo bin kolet hin numba three Ballon DOr las Monday and na bitwin hin and Messi wey don win am since 2009.
Posted on: Wed, 14 Jan 2015 17:21:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015