Dem say Boko don poison BEANS and I don buy half bag keep for - TopicsExpress



          

Dem say Boko don poison BEANS and I don buy half bag keep for house. So, from the one wen I cook, I give my DOG (bingo) make he first taste am, 45minutes leta bingo still dey waka, den I eat my own. After I eat finish, my gateman (Audu) run come tell me say bingo don die, I run quick quick enta house dey turn 4litres of palm oil for belle to quence poison, as I come out my gateman come dey tell me say the driver wey kill bingo wan come beg me. If na you, weytin you go do the gateman?
Posted on: Wed, 05 Jun 2013 12:42:34 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015