Dortmund get injury wahala Borussia Dortmund go waka go Zenti - TopicsExpress



          

Dortmund get injury wahala Borussia Dortmund go waka go Zenti St Petersburg take play dia Champjons League round of sixteen match on Tuesday wit plenti injuri wahala for de Germany team. Manaja Juergen Klopp don alreadi promise dia fans say tins go change afta Hamburg bin waya dem 3-0 for Bundesliga for wikend Like say e neva reach, Dortmund no go dey wit dia sabi midfielder Sven Bender afta de guyman injur and dokitas sef don relate say na ten weeks hin go siddon for house be dat. Tins go change for dia, Klopp yarn as Dortmund bin dey prepare to waka enta Russia. Dem sef go know say Zenit no be moi-moi as dem get ogbonge playas like Brazil strika Hulk, and foma Arsenal winger Andrei Arshavin for dia team. We dey fit, we dey kampe dey wait for dem, and wetin dey be say we head too strong, Zenit midfielder Anatoliy Tymoshchuk Zenit direkto of sport Dietmar Beiersdorf bin dey for de matc wey Hamburg waya Dortmund for Imtech Arena but hin sef feel say dat one no mean. Na Dortmund all men still dey luk say dem go run tins for de match,de foma Hamburg coachi bin yarn. E go solid make we sef show say we sabi tap. De yawa for Zenit be say dem neva tap ball since December 6, but dem manage win dia las match on Saturday as dem beat Estonia team Narva Trans as dia new strika Salomon Rondon bin score de two gols wey win de match. Zenit Italo coachi Luciano Spaletti yarn say: Zenit dey kampe dey wait for Dortmund, afta hin team bin win four inside de five friendli matches wey dem play for Qatar, Israel and Turkey during dia winta break. Klopp bin para for hin team afta Hamburg do dem shege as hin no wan bilif say na de same Hamburg wey lose dia las eight matches wound dem like dat. But Dortmund sabi defenda Manuel Friedrich don ice water d matter yarn say dat kain mistake no go hapin again lai lai. Dat match na yawa, e no go hapin again, Friedrich yarn. If we play de way wey we sabi, we go fit beat anybodi for field. Apat from Bender wey go miss de match, Dortmund don short wit Neven Subotic and dia winga Jakub Blaszczykowski. Ilkay Gondogan, wey neva tap ball since August go miss de match. But strika Robert Lewandowski wey no train go still enta plane follo dem waka go Russia for de match.
Posted on: Tue, 25 Feb 2014 12:03:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015