E don burst today wey be Boxing Day. BOXING DAY BOUT IGBUYA - TopicsExpress



          

E don burst today wey be Boxing Day. BOXING DAY BOUT IGBUYA vs ANIRAH. Oya make unu waka come Sapele Stadium today to wikness the boxing bout btw Chief Igbuya Okrimini and Chief Felix Anirah. Igbuya na man wey get 500kg punch and he rebu for head, belle and voice. Anirah na man wey old small and he get shinning face and wyte hair but he still get 500kg punch even though say he lekpa for where Igbuya dey. Today na today and na d following nai go tanda to make swure say dis bout get effizy. GEE ONE- Refferee SOLO ABEKUS- Vice Ref. JOSPHEFU ASTEYINKU- Bell ringer. EJAIFE ODEBALA- Ring Cleaner SUNNY NWAKEGO- Blood Cleaner MONDAY ASHIAKA- Jaxx Blower LADY JUDY NWACHUKWU- Cheer Leader DJ INFINITY and DJ WIZZY- Musik supplier MC OTOTA and BITTER ICE CREAM- Annousers OMASAN OLOLOLO- Ticket collector VIKTOR ASIKOLO- Security DR ADU- Ambulance Unit DR. Mrs AGBATUTU OKPARAVERO- Mortuary Unit. Everytin dey for dis boxing today. Time na 2pm and dem go show am LIVE for Super Sports 12. Na me High Chief OKPUBULUKU AKPOGWOR, founder/Ceo Sapele Tafia nai sponsor dis fight and na my pishure nai dey unda dis post so. Come and xperience Goko Cleanser and Kpomo Lips from dis two hefty weight. Gate fee na N5.
Posted on: Fri, 26 Dec 2014 10:49:13 +0000

Trending Topics



class="stbody" style="min-height:30px;">
galau bener dah hidup -_- E-Books about Hacking ☣ Download For

Recently Viewed Topics




© 2015