E get one particular restaurant wey I dey chop 4 G.R.A. E get one - TopicsExpress



          

E get one particular restaurant wey I dey chop 4 G.R.A. E get one oyibo wey dey always come chop there too. Anytime dis oyibo chop finish, he go shout Hey. So I wonder wetin dey make am shout. I decided to chop wetin d oyibo dey always chop so maybe me sef go shout too. When I reach d restaurant yesterday evening, I ordered wetin d man dey chop. Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am, but i no shout. I even collected extra plate, but I no still shout. I say dis oyibo na mumu o, why e dey always shout like dat now? Na then I just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na #75,000 then d extra plate too na another #75,000. Na then I shout hey! heyy!! heyyy!!! heyyyyy!!!! heyyyyyyyyy!!!!! heyyyyyyyyyyyy!!!!!!!! heyyyyyyyyyyy!!!!!!!!!! heyyyyyyyyyyyyyy!!!!!!!!!!!!!!! heyyyyyyyyyyyyy!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!! ........... I still dey shout till now...e gba mi o!
Posted on: Mon, 30 Jun 2014 05:44:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015