E get sum kind things wey this Edo governor, Adams Oshiomhole dey - TopicsExpress



          

E get sum kind things wey this Edo governor, Adams Oshiomhole dey do sometimes wey I no just like at all In fact, as I dey talk so, I dey Vexxxxxxxxx Oga governor, dat day wen you seize that woman goods for Mission Road, you no see my grandma own for there?........ Na my grandma own even block road pass that woman own if we say make we really talk am My grandma tell me say on dat day, say she dey shout dey tell Oshiomhole say Comrade governor abeg seize my own, Comrade governor abeg seize my own......... But the governor no gree listen Oga governor, abeg next time, if you wan give punishment, try make you punish everybody........ No be say you go punish 1 & leave the other..........Because na this 1 oyibo pipo dey call Selected Justice If to say you follow seize my grandma goods dat day......... By now, my grandma & that woman for share dat 2million 50-50............ She take 1million while my grandma take 1million.......... & that money for really go a long way to solve sum kind family issues.
Posted on: Wed, 04 Dec 2013 10:56:30 +0000

Trending Topics



style="min-height:30px;">
Noticia: Reunião Coordenadores Saúde debate com coordenadores
Truyện Dài Kỳ: CON DÂU NHÀ GIÀU - Cuối cùng cùng
I LOVE THURSDAYS featuring Club997 on 99.7fm Resident DJ DANNY

Recently Viewed Topics




© 2015